|
Mai dia people of obodo Naija, I salute una! Come see
me see trouble oo, na so man pikin sidon for house Bolanle come call me
say make I come see for CNN how one aeroplane take nose hit the place
wen all de world dey take trade.
Eewoooh! As I dey shout and efrybody dey hala na so I
see anoda Boeing 7 someting come again come hit am again gbosa. Wetin
dis awa world dey turn to? The first ting wey come my mind na say
my friend Chike be Taxi driver for New York even do wen im come Naija ee
dey tell us say im be CEO for one big koporashion wen dey for weda na
Window street or Wall street, me sef no kuku remember. Anyhow we find am
out wen dem show am for TV wen Obasanjo go Amrika. Na im drive awa NTA
Television people. Even im Mama sef dey tell efryone for awa town now
say Chike im be Chairman for Korporation Feed de Nation for Amrika.
Rumour carry am say na for dat Korporation im bring dat salt wey im come
share for all the womans dem for awa town.
Anyhow, as I dey talk before abi na befive, as I see
dis ting for CNN, I come tink one ting wey my Grand Papa tell me say
even if you no like person, at least make you pity am small. Dem say
those people carry de plane do suiside, me I take mai koro koro eye see
am for CNN. Me with Bello mai Suya still dey argue am. Aeroplane wen I
see take front of de nose hit de Oshodi market of Amrika, dem say
na side it take hit. I tell Bello say na SUIFRONT no be suicide.
Me I salute all de pepoos of Amrika and all mai dia
Obodo Naija Mans and Womans wey dey for all Amrika. Una sorry ooh!
Bible talk am say love dai nebo na de reason wai me I
dey popular in de eighties well well wen dat big disease wit small name
nefer begin make Papa Friday begin stay house for evening. I really love
mai nebo well well in those days, I love Funke, Hajia Binta, Ijeoma,
Rhoda, Agnes, I really pratis wetin Bible talk wit mai nebo. Anyhow dis
days wen I see womans even if dem paint dem face laik mammy water, I go
just hide mai face make I no see all the milk industry wey dem carry and
the Ikebe wey dey do acrobatic for dem behind.
Dese days na awa House of Assembly people de love dem
nebo well. Chei! Come see as awa unifasity and Politeknik womans dey
take spend dem money. Some of dem dey go party for London, Paris and
efen New York.
Eheh now I remember say na wai I com dey write
una. As dose aeroplane take hit Amrikan Oshodi market, as I see de
people dey run, I tink say dem dey run to catch molue but Bello mai Suya
tell me say dem no get Ojuelegba bus stop for New York. Wetin I sabi? me
I no know book so make una no moles me. Before I forget, as all dis
people dey run, gofament for Canada, Japan, U.K. dem dey work skata,
skata to see if any of dem people dey for dia. Bro Segun? wetin una do,
How many of awa Naija mans and womans dey for dia? How many make am out
of dia alaif? Beta question be say una send any womans to go shop for
dat area?
As dis ting dey happen, na so Amrika Air Force take
dem Presido aeroplane wey dem dey call Air Force One dey take dodge wit
Mr. Presido so dat Terrosist no go fit find am, if na for Naija na so
dem for go catch our Presido laik fowl. Even Amrika dem law makers dem
carry dem put for bunker dey plan de nest step, for Naija na so our
lawmakers for don run from Abuja go de smallest village for Kogi state
or hide for under bed.
All of una politishan, make una learn say de pawa wen
una get now na de most impotant ting wey una go efer get. Ee strong pass
money, make una use am proper proper. For exampu if to say Okadigbo
carry all dat money wen dem talk say im take build garden go build
waterworks or Eletrik for im village, efry Igboman and efen other traib
for come to im defense but de man carry am go build garden. Which kain
garden im take all those Millions build? Then again maybe im wan grow
plenty rose to give all the Babies wen dey come see am.
Till next taim, I salute una! Me sef get email so if
una wan reach me, una fit dial bobonaijaman@idoma.net
|